Saturday 17 November 2018

Una Welldone oh

Una Welldone oh.  Na me be Anty Juli una sister.  I don carry my market come oh.  Make una de waka come dis my yard for una everyday gist. I go give una news as e dey hot. If dem mess for Aso Rock,  una go hear for this our yard. 

Anty Juli yard na place wey una go get authentic news,  gist,  entertainment and many more. We no be like Ogogoro wey dem don use water mix.  Na we be the ogbonge, original,  correct place for every every.

Na we get Aso Rock. Na we get Lagos,  Abuja,  Port Harcourt and all the 36 states for our Obodo Nigeria.  If una get gist make una hala Anty Juli.

We no go disappoint. Una go dey entertained,  educated,  enlightened, empowered and many more. 

Make una join us!  Be part of us. 

No comments:

Post a Comment