Sunday 18 November 2018

PDP don pick Senator Kashamu as Ogun State Governor candidate


Senator Buruji Kashamu na the person wey go carry Peoples Democratic Party (PDP)  flag for Governor for Ogun State.



PDP choose Kashamu after one  Mr Adeleke Shittu commot for the race say he no do again

No be say dem fight o,  na Shittu and dem PDP leaders siddon come reason say if dem put Kashamu,  e go dey better for PDP as dem go get upper hand for Ogun State gubernatorial elections for 2019.

Kashamu’s  media   aide, Mr. Austin Oniyokor,   talk say na the leaders of the party na dem beg Kashamu make him come replace Shittu.


Na former presidential spokesman Reuben Abati go come be Kashamu deputy.


Hear wetin Onyiokor talk:



“I can confirm to you that Mr Shittu  last week Friday signed the withdrawal  letter and at the Senate he has informed INEC of his withdrawal from the race.”

Anty Juli de hia dey watch una.

No comments:

Post a Comment