Monday 19 November 2018

See Wetin Ritualists Do This Fine Girl

One Elozino Ogege wey bin lost for four days don die.







According to reports wey Anty Juli get,  dem find Elozino a 300 level student of Mass Communication for Delta State University dead body for along Ekrejeta road for Abraka.


When dem find Elozino dead body her tongue and breasts no dey, as some evil people don cut am commot.

 Dem say Elozino na first class student.

Delta State Acting Police Public Relations Officer, DSP Andrew Aniamaka, who confirm the sad matter say Elozino family no get themselves again, as their tears and sadness dey flow like water.

 Chai..... May her soul find peace.

No comments:

Post a Comment