Monday 19 November 2018

N1. 2bn theif theif: Fayose trial don start

Nigeria money police,  the Economic and Financial Crimes Commission don begin trial of forner Ekiti State Governor,  Ayodele Fayose.

EFCC talk say Fayose theif N1. 2 billion take do him election campaign, buy house for Abuja.

Fayose and him company Spotless Investment Limited na im EFCC drag come court.



Wetin happen for court today be say,  EFCC call four witnesses make dem come testify against Fayose

Read wetin one of the witnesses Mr Lawrence Akande, Oga banker for Zenith Bank talk:

 " One Abiodun Agbele called me. Afterwards i received a call from Fayose.


Prosecutor:  Tell the court if the People’s Democratic Party (PDP) maintained an account with your bank,”

Witness: Not only PDP, but so many other political parties.

The witness come talk say Senator Musiliu Obanikoro also join the money parole.

Akande talk say na with aeroplane dem take move the N1 2bn go Akure.

Akande come talk plenty say dem transfer the money enter Spotless Nig. Ltd, De Privateer Ltd as well as personal account of Fayose while the remaining  cash them carry go  Ado-Ekiti.


When Judge wey siddon on top the matter hear the plenty talk,  she postpone the matter go January 21, 2019 for Fayose matter to continue.

No comments:

Post a Comment